Thursday, November 5, 2015

Blog Reader Has Special Aproko Gists For Us


 Hello lailaicious baby,

How u dey? Hope body dey kampe.....

Well, I just say make I entertain my special TILB with some old and new aproko matter.

My people, how una dey? How everi every. Hope say no be inside hold up you dey read this interesting matter.If na inside hold up....biko grab gala and Lacazobo to recharge your system.

Hmmmmm, like play, like play. ..Bros Anthony the sharp guy don carry our Annabel go....Honeymoon loading. Na him person say Austin dey dere dey form ladies guy.





Bros kclub dey search for flat tommy and fair sisi... (very expensive taste). Kclub, dem say make u waka go china....say ur taste plenty dere.

Mr Jupiter. ..a.k.a Eddy-Wiz is being punished by Bonita. Haba...Make una forget forming and be real biko.
Upon how Esteri dey try match make una, na still dey form I get taste. Hope say, una no go jam Catilyn Jenner before una eyes clear.

Dem say Bros Derrick go dey form heartbreak..plus am not ready now. Lol. The whole scenario just funny. Girls wey dey single don use am sing. So tey, nobody notice them. Na those one wey dey form. .dem carry their sokoto dey pursue like lotto.

Imagine babe like. ..Vee cee..a.k.a..Laila's blog baby. .Announce vacancy, Austin pretend like say him no see am.


Juliet Ogechi, Announce vacany, Obinna Azubuko do like say him no see am.Only for Bros Obinna to dey ask for Saturday number. ..Guy wake Up.

The one wey funny pass na how Esteri don give nonoristic bobo all d babes. ..even Nono...a.k.a Nosa. ..No sabi him bae again. ....Nono. .take heart. ...Ur bae dey here...soon we go unveil her.

Lisa Peter. Correct bae..no dulling. ..how Hector? Hope d message is increasing all day.We happy 4 u ooo. .sharp gurl.

Miz Tee. ..Since you no let us know who you dey crush on, Abiodun Olaniyan don confess oooo...he say, him be your secret admirer. Go and grab ur copy now now b4 flacko decide to take u to papa.

Oga Breeze, na only you waka come? Na all forms you just dey fill like person wey dey apply for scholarship. Guy park well jawe. ....Barong is waiting already.

Anwuli, Austin says he is your number one fan....Hope you understand wherever you are.

Zombie huntress is hooked already. ...Atleast she send us her wedding cake picture.

Carina Jacob, how is bros John Andza?

Bros kclub. ..we don help you put your taste of bae on OLX advert. .. Just kotinu to wait.


http://ift.tt/1Wy9v9o


He be like say some of una sabi this aproko pass me...Abeg feel free to hit us with the latest. ...Body dey pepper us to hear the Koko.

I sit don here for more Aproko. ...See you next week my Fipu.


Still remain my humble self
Inspector Nifemi.

from Nigerian: Breaking News In Nigeria | Laila's Blog http://ift.tt/1Wyb5YJ
via IFTTT

No comments: